Fela Kuti – Look and Laugh, Pts. 1 & 2 Lyrics

Look and Laugh, Pts. 1 & 2 Lyrics By Fela Kuti

Look and Laugh, Pts. 1 & 2 Lyrics
Look and Laugh, Pts. 1 & 2 Lyrics
  • Artist Fela Kuti
  • Title Look and Laugh, Pts. 1 & 2
  • Album Teacher Don't Teach Me Nonsense

I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)

I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too, oh (hey, hey)

Since long time, I never write new tune
Long time, I never sing new song
Long time, I never write new tune
Long time, I never sing new song
Many of you go dey wonder why, your man never sing new song
Many of you go dey wonder why, your man never write new tune

My brother no be so, tabi, no be say, tabi I wan keep quiet
My brother no be say I no wan write new
Song for you to make you think and happy

Wetin I dey do be say
Wetin I dey do be say (dey look and laugh)
I say wetin I dey do (dey look and laugh)
I dey look and laugh (dey look and laugh)
I say wetin I dey do say (dey look and laugh)
I dey look and laugh (dey look and laugh)
Ṣe the things wey me and you (dey look and laugh)
Don see for this country (dey look and laugh)

No reach for me (dey look and laugh)
To dey looku and laugh (dey look and laugh)
Wetin I no sing (dey look and laugh)
About in this country (dey look and laugh)
Sing, sing, sing (dey look and laugh)
'Til dem come (dey look and laugh)
Come charge me (dey look and laugh)
For armed robbery (dey look and laugh), sey
I must looku and laugh (dey look and laugh)
I must looku and laugh (dey look and laugh)

I dey say make you bring your ears nearer to me
And hear the experience I sing about (dey look and laugh)
I say, wetin I dey do be say (dey look and laugh)
I dey look and laugh (dey look and laugh)
I say, wetin I dey do (dey look and laugh)
I dey look and laugh (dey look and laugh)

I dey say make you bring your ears nearer to me
And hear the experience I sing about (dey look and laugh)
I say, wetin I dey do, say (dey look and laugh)
I dey look and laugh (dey look and laugh)
I say wetin I dey do, say (dey look and laugh)
I dey look and laugh

READ ALSO  Hunxho – Where I'm Going Lyrics

Haha-haha, hehe-hehe
Haha-haha, hehe-hehe
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too, oh (hey, hey)

Watin man go dey do when na for e eye
Ọbasanjo pass government to shagari ooo
Shagari rule e government regime for four years, no head, no tale
Inside this no head no tale
Same water, no light still dey

Shagari himself say
"The economy of the country is collapsing"
Then those old people
Wey do upga for 'im eye
Carry walking stick cometo

With ah PP 'ay, no PPP
Hey, hey
Who say PPP? Nah PP 'ay
Ooh!

All for 1983 (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
All for 1983 (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
Watin I no sing (look and laugh)
About this country (look and laugh)
Sing, sing, sing (look and laugh)
'Til dem come (look and laugh)
Come charge me (look and laugh)
For armed robbery (look and laugh)

I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)

Haha-haha, hehe-hehe
Haha-haha, hehe-hehe
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too, oh (hey, hey)

Contractor and minister or commissioner make agreement to make road
All of us know how long government dey take to make road for here
Then the road start as dem don put machine, sands, and stones
As the road start Shagari make announcement, contractor self make e own
Contractor say as the economy don go, things don cost, so road must stop
Government say, "No more money contractor, say no more road"
Contractor go, government stay

Ah, ṣe that one no reach laugh? (Look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
Ṣe that one no reach laugh? (Look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)

READ ALSO  FOLA – you Lyrics

Which kind wayo be that (look and laugh)
Ojukwu stealing (look and laugh)
Original stealing (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
Wetin I no sing (look and laugh)
About in this country (look and laugh)

Sing, sing, sing (look and laugh)
When them come (look and laugh)
Come burn my house (look and laugh)
All my property (look and laugh)
Burn, burn dem o (look and laugh)
Beat, beat me (look and laugh)
Kill my mama (look and laugh)

I must to look and laugh (look and laugh)
I must to look and laugh (look and laugh)
Watin I no sing (look and laugh)
About this country (look and laugh)
Watin I no sing (look and laugh)
About this country (look and laugh)
Sing, sing, sing (look and laugh)
Four years later (look and laugh)
'Til dem come (look and laugh)

Break, break the house (look and laugh)
The house wey I dey stay (look and laugh)
Dem come beat, beat me(look and laugh)
'Til dem think say I don die (look and laugh)
When I get up (look and laugh)

Dem tie my hands, dem tie my legs (look and laugh)
Dem throw me inside police van (look and laugh)
I must to look and and laugh (look and laugh)
I must to look and laugh (look and laugh)
Dem come carry me go (look and laugh)
Dem come charge me for (look and laugh)
Charge me for armed robbery (look and laugh)

I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
I must look and laugh (look and laugh)
I must to-

Haha-haha, hehe-hehe
Haha-haha, hehe-hehe
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too (hey, hey)
I chuckle too (hey)
I chuckle too, oh (hey, hey)

Look at our television and listen to our radio in Nigeria
When dem don do their nonsense finish, newspaper sef go join
My own be say too many overseas things and our own too small
When dem do our own wey small sef dem go be yeye things
No plan, no set, no ideas inside dem
Dem go dey copy for overseas dey go
Government this, government that, in their tiles lace and dongaris

READ ALSO  Fela Kuti – Confusion (Edit) [feat. Africa 70] Lyrics

Ah, ah, ah
Hey
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu, laffu, laffu (hey)
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu, laffu, laffu (I no, no)
Ṣe I no no wetin dem (I dey laffu) do inside television
Lookuu, looku, looku (I dey laffu)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)

Police uniform come important pass food for this country (I dey looku)
Looku, looku, looku (I dey laugh)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)
Go to court, na big-big English (I dey laugh)
And still dem dey do their nonsense (I dey looku)
Lookuu, looku, looku (I dey laugh)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)

1809 book dem go bring (I dey laugh)
To judge case of 1980 (I dey looku)
Lookuu, looku, looku (I dey laugh)
Laffuu, laffu, laffuu, ooo (hey)
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu, laffu, laffu (hey)
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)

Government people still dey enjoy go (I dey laugh)
With police support o (I dey looku)
Lookuu, looku, looku (I dey laugh)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)
Nigeria still dey where e dey (I dey laffuu)
Poor man still dey plenty more (I dey looku)

Lookuu, looku, looku (I dey laffuu)
Laffuu laffu laffu (I dey looku)
Government people still dey enjoy go (I dey laffuu)
With police support o (I dey looku)
Lookuu, looku, looku (I dey laffuu)
Laffuu, laffu, laffu (I dey looku)

Nigeria still dey where e dey (I dey laffuu)
Poor man still dey plenty more (I dey looku)
Lookuu, looku, looku (I dey laffuu)
Laffuu, laffu, laffu o (hey)
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu, laffu, laffu (hey)
Lookuu, looku, looku (ya)
Laffuu laffu laffu (I dey looku)

I must look and laugh (I dey laffuu)
I must look and laugh (I dey looku)
I must look and laugh (I dey laffuu)
I must look and laugh (I dey looku)
I must look and laugh (I dey laffuu)
I must look and laugh (I dey looku)
I must look and laugh (I dey laffuu)
I must look and laugh (I dey looku)
I must look and laugh (I dey laffuu)
I must look and laugh (I dey looku)

Heey (I dey laffuu)
(I dey looku)
(I dey laffu)
(I dey looku)
(I dey laffu)
(I dey looku)

Leave A Comment