Ole Lyrics By Falz

[Intro]
Many still ain’t really free
Many losing all the will
Many soldiers in the field
Many brothers dem dey kill
Many stealers wey dey feast
But we no fit enter streets
Many people wey dem kidnap
And dem turn them to deceased
[Verse 1]
Don’t think that you can whip up tribal sentiments for life
Keep keeping people poor and hope that you can weaponize
Hope that you can bank on all the hungry votes that you can buy
Just to get it and repeat the same cycle all thе time
We sef—
Comе make we talk, gimme one second
How many we go take before we don fed up?
Inflation rate high like my blood pressure
Dem go say make we no protest say na wrong method? (Mtcheew)
Fuck all of your gimmicks, you no get the courage! (Mmm)
Shebi na dat side wey you dey find your solace
Cockroach on the ceiling, ibo lo gba wole?
Eba mi kigbe, “Ole!”
(Ole!)
[Verse 2]
Me na cold water, but if e need, I’m really stubborn
Make I lecture dem ‘cause common sense no really common
Wait—
Security, welfare na the primary job you take
Try grow some fucking balls and don’t be acting unfortunate
Who get serious mind dey follow terrorist negotiate?
Just wipe out their whole lineage
You sef no want commot balaclava for your face, turn to martyr
Before e scatter now and street start to dapada
Nobody go save you, if you like, you call alagba
For under your nose, dem kill a whole brigadier general
Dem no dey fear, try dey hide their face? E dey for camera!
Some dey livestream, some dem dey kill police commissioner!
Commot him uniform, then wear am come for meeting wit una
For under your nose, dem carry people children go
Plus school teacher wey dey teach, cut him neck, post the video
Who dem catch for the crime? Arrest count still on zero
Person pikin wey dey orphan, person wife wey dem widow
[Part II]
[Verse 3]
Water, light, food, house, na the basic
Where hospital wey go treat person wey sick?
Small pikin go go school, him papa go need work
Technology dey run, shey you no intend to meet up?
Na wah—
See your border, how you leave the door (Ajar)
All the focus, what you want to chop (Na bar)
Tief wey you tief us no be small (Matter)
And still you pray in the name of Jesus (and Allah)
[Outro]
And every day
Many dey pretend, then they sell us to the West
And they tell us how to dress
And they teach us how to mess
Oh, you acting like you care, you put your mouth in my affairs
Said you’ll stretch a hand of help when you’re the reason why I’m here
In the first place
Gimme my belongings o, ole
Every day for the thief, I still dey wait for my one day
Many promises, too many times, many phonies
Fraudulent politics, many lies, many stories