Umbrella Lyrics By Moses Bliss

Because my Papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my Daddy dey for Him throne
Observe my life oh
See the way e align oh
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
My Daddy cover me
Cover, cover, cover
Give Him angels charge over me
Over, over, over
Dem no fit koba me
Koba, koba, koba
Odeshi dey for my body
Wetin you see?
Wetin you see
For my body
For my body
Wey you dey carry me go?
Na you dey carry me go
I dey under the canopy
So I no get wahala, I get no p
When dem try to put am for my body e bounce
'Cos Jehovah e cover me (Cover me)
Your love no dey stop, e nor get e check point oh
Everything You do is on point oh
Lord, na my head wey You anoint oh
Your grace no dey rest, e dey always dey follow me
Your joy be my strength, e dey power me
No other power fit to oppose me (Oppose me)
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
Twenty-four seven, You be God
Na You get all power
I dey steady dey collect oh
'Cos na Your hotspot me I connect oh
If you check am
Oil dey my head, you dey see am wella
Olorun Oba, na You set my ladder
Anytime I step inna the place na fire
By the grace of God, the gbedu dey sama
Planted by the waters I nor need mai ruwa
If you know my name, omo na God dey do am
Amarachukwu jejely dey lift me higher, higher, higher
Under your canopy, Papa You cover me
Sey na You wey dey give me ability
I get Your backing, Your agility
From now till eternity
(Till infinity)
So, my brother my sister
Na baba dey carry the boy go far
Anywhere I enter
Moves monumental
Inside him plans, na me dey for the center
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh
Because my Papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my Daddy dey for Him throne
Observe my life oh
See the way e align oh